Former Super Eagles and current Enyimba striker, Brown Ideye don come outside dey blast Enyimba of Aba say: Enyimba no be football club o. In fact Enyimba dey operate like mechanic shop wey dey treat players like apprentice wey dey learn work. Because tell me why this club go dey give professional football 7,000 naira every match day for food.

I mean, if we travel for away match, instead of make the club lodge us for correct hotel wey go serve us correct food, dem go carry us go lodge for bacha give us 7k per day for feeding morning afternoon and night. Na so whenever we wan chop we go begin find Iya Bashira bukka to chop. Many of these players get family for house o, so instead of to chop well dem go rather buy amala or okele, some go chop rice without meat. Some go even drink garri so that dem go take the money wey remain back home as wetin dem bring come.

And na only 2 days dem dey give us that 7k o. If dem give us on Friday and Saturday wey we get away match, from Sunday wey we dey return back to Aba, nothing for us. Our match bonus na 15k per match for players wey play the match. Others na 5k, but na for end of season dem dey pay match bonus make e look big for our eyes.

My brother players dey suffer o. Players dey suffer well well. Especially for me wey don play Europe see how dem dey treat footballers there. Imagine enter bus from Aba to Kano on Friday and you get match on Saturday. No be tired legs you go take play that ball?

My people how una see this casting wey Ideye cast Enyimba so?
Former Super Eagles and current Enyimba striker, Brown Ideye don come outside dey blast Enyimba of Aba say: Enyimba no be football club o. In fact Enyimba dey operate like mechanic shop wey dey treat players like apprentice wey dey learn work. Because tell me why this club go dey give professional football 7,000 naira every match day for food. I mean, if we travel for away match, instead of make the club lodge us for correct hotel wey go serve us correct food, dem go carry us go lodge for bacha give us 7k per day for feeding morning afternoon and night. Na so whenever we wan chop we go begin find Iya Bashira bukka to chop. Many of these players get family for house o, so instead of to chop well dem go rather buy amala or okele, some go chop rice without meat. Some go even drink garri so that dem go take the money wey remain back home as wetin dem bring come. And na only 2 days dem dey give us that 7k o. If dem give us on Friday and Saturday wey we get away match, from Sunday wey we dey return back to Aba, nothing for us. Our match bonus na 15k per match for players wey play the match. Others na 5k, but na for end of season dem dey pay match bonus make e look big for our eyes. My brother players dey suffer o. Players dey suffer well well. Especially for me wey don play Europe see how dem dey treat footballers there. Imagine enter bus from Aba to Kano on Friday and you get match on Saturday. No be tired legs you go take play that ball? My people how una see this casting wey Ideye cast Enyimba so?
Like
1
0 التعليقات 0 المشاركات 146 مشاهدة 0 معاينة