As Juventus don jabo from FIFA Club World Cup wey dey shele inside America, their coachie, Igor Tudor don knee down dey happy say: thank God say we don finally jabo o, because the heat for that America, e be like say na hell fire we dey. Walai talai if dem put you for that sun and dem pour you maggi, salt and pepper, na human barbecue that pesin go turn to because that sun hot pass oven. Na only 5 substitutions FIFA give us but my 10 players wey dey pitch dey beg me to remove dem before dem turn to kpomo. Even the ones wey dey bench dey pray make I no put dem sotay one player even tell me say if him enter this match as a human being, him fit come outside as bonga fish. Walai the heat show us shege we begin carry hand fan dey go everywhere we dey go like all this ajebo ashoebi girls. Heat na bastad o.
My people una don hear Juventus coachie side of the story. Shay na true him talk abi na excuse him dey find?

0 Comments
2 Shares
197 Views
0 Reviews