“Before She Say She Be 35, Just Know Say She Don Dey 45… And Na Una Cause Am!”
These days ehn, woman no fit talk her real age again without fear. Before one babe go open mouth talk say she don reach 33+, she go first look left, look right, check who dey the group chat, calculate who go judge her… then she go settle for “I’m just 29 going on 30.”
But who cause am?
Na some of una!
Yes, you!
You wey dey always open mouth dey shout:
— “33+ women na iron condemm
— “She don old.”
— “Na desperation age.”
— “She go soon rush go marry.”
Una don use una mouth finish 33+, now women dey use filter for birthday age. You go jam 45-year-old wey dey say:
“I’m celebrating 35 for the 3rd time!”
But guess what?
33+ women na the real deal!
Na dem strong pass.
Dem don cry, wipe tears, wear makeup and still show up looking like success.
How to Know a Real 33+ Babe (Wey No Get Time for Nonsense):
1. Her Peace of Mind Na Full Package – She no dey do “talking stage” wey go last 6 months. You either show working or shift.
2. Her Skin No Be Noise – She dey glow with confidence, not clout. Her stretch marks na tiger stripes of survival.
3. She Go Love You and Still Chase Her Bag – She no dey wait for man to define her life. She go support you, invest in you, and still slay on a budget.
4. She Don Outgrow Rubbish – If you carry childish behavior come her side, she go air you like bad network.
So before you open mouth ask woman “how old are you sef?” like na job interview, remember say age no be disease.
Some of you wey dey drag 33+ women never even figure una life at 28.
Dem wey una dey mock don already build business, raise children, and still look finer than una 21-year-old crush wey dey use Snapchat filter like face mask.
Moral of the storpllloy:
No dey pressure women to lie about age.
Na age wey show strength, growth, and beauty.
33+ no be end of the road — na where wise women start to shine without apology.
p
Support her. Respect her. And no ask her age if you no fit handle the answer.
Hope you learnt something.??

🔥 How to Know a Real 33+ Babe (Wey No Get Time for Nonsense):

Dem wey una dey mock don already build business, raise children, and still look finer than una 21-year-old crush wey dey use Snapchat filter like face mask. 😭