The oga kpatakpata of police inside London, Sir Mark Rowley don come outside dey complain say: Football clubs inside this London suppose to dey pay 70 million pounds per year for police security during matches. I’m telling you. Because you see the fans of some of these clubs, their wahala too much. Some of them all their fans na agbero. Some of dem na conductor and area boys full there. Na so dem go smoke igboh and mkpurummiri finish top am with ogogoro enter stadium begin misbehave. If you see wetin police dey see after match when these fans begin fight each other outside stadium you go know say MC Oluomo boys dey learn work for Oshodi. E get one particular club wey their own naim worst pass. I no wan mention names but the fans of that club know demsef. Everyday na so dem dey behave like Under Bridge motorpark touts and whether dem win or lose dem must always fight each other. In short na only that club suppose dey pay half of that 70 million police tax because their own too much. I no wan mention their name, but that club know demsef.
My people una don hear wetin this oga kpatakpata of London police talk. Abeg na which particular club naim the man dey refer to so?